Saturday, May 31, 2014
Devil call Boko Haram, the following
conversation was made:
DEVIL: Helo!
BOKOHARAM: Helo who i dey talk wit?
DEVIL: dis is devil, i want to speak to Boko
Haram.
BOKO HARAM: yoowa! U ar welcm to
Bokoharam. watin can we do 4 u?
DEVIL: the thing wey una dey do shey e
gud?
BOKOHARAM: Watin we do?
DEVIL: Una dey fall my hand no b smal o.
BOKO HARAM: Devil Watin hapen? talk to
us.
DEVIL: U colect my title finish u dey
ask me watin hapen
BOKO HARAM: na whch title we colect frm
u?
DEVIL: No dey ask me rubbish, shey u go
tel me say u no know watin una colect frm
me?
BOKOHARAM: We no knw abeg yarn us na.
DEVIL: since una come out i don luz my
respect. People no dey fear me like b4
again. Una wan take ova frm me abi?.
Evrybody now dey fear una.
BOKO HARAM: Devil watin make u talk so?
DEVIL: go to d street an see 4 ursef, na
una word dem dey talk
up and down, dem dey panik, 4 radio nko
dat one na daily basis, 4 TV dat one na
evry hr. What of church, na una b d prayer
point.
How una take do am wey evrybody com
dey fear una pas
me d Devil?
BOKO HARAM: Hahahaha u wan
knw watin hw we do am?
DEVIL: yez now tel me d secret wey make
people dey fear u mor
than me.
BOKOHARAM: Oya tel us wia u dey stay?
DEVIL: Why u dey ask wia i dey stay?
BOKOHARAM: nothin, jux giv us ur adres
DEVIL: Abeg make we leav dat one jo.
BOKOHARAM: jux tel us ur abode thats all.
DEVIL: dats nt all o. Bokoharm Una
don start again, i get wife and pikin 4 haux
o.
BOKO HARAM: What does that mean? Ar u
afraid of us?
DEVIL: I dey craze? Why i no go fear? Una
no wan make i live long abi? Abeg make
una take over, no
problem. (Make i cut d phone b4 Dem
track dis cal)...
Lwtmb... Moni pals........api wkend
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment