Tuesday, October 1, 2013

Akpos Akpos The Comedian
Akpos Story!!!

E get dis restaurant wey i dey chop for Gariki. One oyibo dey always come chop there too. Any time dis
oyibo chop finish, him go dey shout “hey!!!”, so i wonder wetin dey make am shout.
I decide to chop wetin the oyibo dey always chop, so maybe me self go shout too. When i reach d
restaurant last week friday, I order wetin the man dey chop, dem tell me say na chicken and red wine, so i
chop am.
I surprise say i no shout, i even collect extra plate, but i still nor shout. Na then i just vex ask for my bill.
The waiter tell me say one plate of chicken and red wine na N45,000, and the extra plate na another
N45,000.
Na then i come shout heyyyyyyyyy!heyyyyyyyyy!! heyyyyyyyy!!! heiiiiiiiiiii!!!!Untill i reach house i still dey
shout........Happy independence day.

No comments:

Post a Comment